Donald Trump and JD Vance don release dia official portrait

Donald Trump appear for im official presidential portrait for im second term for office. Im look directly into di camera and e look like say im raise im eyebrow. Im wear blue tie and white shirt wit American flag lapel for di left side of im suit jacket

Wia dis foto come from, TRUMP VANCE TRANSITION TEAM HANDOUT/EPA-EFE/REX/Shutterstock

  • Author, Brandon Drenon
  • Role, BBC News

Di official portraits of US President-elect Donald Trump and im second-in-command JD Vance don come out ahead of dia inauguration on Monday.

Both Trump and Vance wear blue suits for di foto, wit white collared shirts and blue ties, Trump wear one small US flag pin for im lapel.

Trump facial expression different from Vance own, di president-elect head bend slightly downward, im raise one of im eyebrow and im lips press togeda.

While Vance smile at di camera, and cross im arms, for a more relaxed pose.

JD Vance stand cross im arms and smile small, im wear blue suit and tie.

Wia dis foto come from, TRUMP VANCE TRANSITION TEAM HANDOUT/EPA-EFE/REX/Shutterstock

Many pipo dey compare di new image of Trump to im 2023 mugshot, wey im bin take for Fulton County prison afta dem bin charge am wit attempting to overturn im 2020 election loss to Joe Biden for di state of Georgia – charge wey Trump don deny.

Trump bin use dis now-famous image to raise funds for im campaign.

Di Trump-Vance transition tok for press release say di foto dem “go hard”.

Donald Trump mugshot from Fulton County Jail

Wia dis foto come from, Fulton County Sheriff’s Office

Di portrait wey Trump choose dis time different wit di image im bin use for 2017, wen im bin first become president.

Although im wear similar attire, im bin smile well-well for di camera for di earlier portrait.

“Trump fit dey embrace a defiant image, transforming from one moment of legal adversity into a symbol of resilience and strength,” na wetin Quardricos Driskell, one political science professor for George Washington University, tell BBC.

“Di big difference to im earlier, more traditional portrait fit also signify a shift for im public persona, to show a tougher, more combative stance as im prepare to assume office for a second time.”

Donald Trump presidential portrait from 2017

Wia dis foto come from, Library of Congress

Na Trump transition team release dis official foto just days bifor Trump and Vance inauguration on 20 January.

Tori be say dem no release di official foto of Trump and im former vice-president Mike Pence until nine months afta dia swearing-in.

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *